EndSARS protest in Lekki toll gate Lagos: Armed sojas fire live bullets at thousands of #EndSARS protesters for Nigeria

EndSARS Protests

Armed soldiers fire live bullets and fire works at thousands of #EndSARS protesters gada for Lekki toll gate inside Lagos, Nigeria.

Tori be say Nigerians no look goment face still continue di #EndSARS protests for Lagos even afta di 24 hour curfew wey goment declare to start from 4pm on Tuesday.

Kasala start wen thousands of protesters wey full Lekki toll gate still dey protest begin hear gun shots for air.

Di next tin everiwia scata and become rowdy. E no dey clear how many wunjure wen e happun around 6:45pm Nigerian time.

Di next tin wey happun na say di sojas don form wall alias barrier gada round di protesters wey no gree run.

Di protesters tanda for ground insists say dem go continue di protest against police brutality.

Latest gist be say Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don order say make di enforcement of di 24hour curfew no start until 9pm to enable pipo wey hook for traffic to get to dia domot.

Lagos goment say at least 30 pipo wunjure for di Lekki toll gate protest on Tuesday.

Skip Twitter post, 1
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 1

Di sojas fire wetin sound like live bullets for up at first, then dem begin shoot fire works wey sound like banga to pursue di protesters, awa tori pesin wey dey dia wen e happun tok.

BBC Pidgin no fit confam weda pipo die or how many die at di time of dis report.

However some protesters for Lekki toll gate Lagos dey claim say pipo dey badly affected afta dis incident happen and pipo die.

Rights group Amnesty International say dem don receive reports wit enof evidence wey show say soldiers bullets kill protesters during Tuesday kasala for Lekki toll gate #EndSARS protest.

But Nigeria Army don post tweet say wetin happun na fake news.

Skip Twitter post, 2
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 2

EndSARS protests

Meanwhile Nigeria Police Inspector General Muhammed Adamu don order anti-riot police unit to immediately enta streets sake of violence for di #EndSARS protests.

EndsSARS protests also make Governor Fayemi order 24hr curfew for Ekiti State from 10pm on Friday.

Also, Nigeria senate don tell President Muhammadu Buhari to address di kontri as soon as possible on top di #EndSARS protests wey dey go on all ova di nation.

Skip Twitter post, 3
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post, 3

Wetin spoil di once peaceful #EndSARS protests?

Anti-riot police unit of di Nigerian Police Force don collect marching order to immediately enta streets sake of violence for di #EndSARS protests.

Dis order wey land Tuesday afternoon from di kontri Inspector General of Police follow how di #Endsars peaceful protest wey begin for early October across Nigeria but begin turn violent since dis week.

For Kano, violence burst for di EndSARS protest inside di northern Nigerian city.

For Lagos State 24 hour curfew for all parts of di state starting take effect from 4pm today. And na only essential workers and front ine responders go fit dey road afta di curfew.

Di Inspector General of Police no stop dia, e also order for massive deployment of police officers dem to prisons dem and make sure say security tight around all di prisons alias correctional facilities plus secure all oda critical national infrastructure for di kontri.

On Monday, jaguda pipo wey claim to be EndSARS protesters cause prison break for Benin and Okoh prisons inside Edo State and burn down two police stations and one police police post.

Di mata make Govnor Godwin Obaseki order 24 hour curfew from 4pm Monday 19 October.

Still on di same day, thugs attack and burn cars for Abuja leading to ethnic attack wey don turn bloody.

For Jos, north central Nigeria, di story no different on Tuesday as attacks di happun for dia and di final bus stop na for Lagos state wey dem burn one police station.

Amnesty International say fifteen pipo dem don die on top di ongoing endsars protest and na sake of dis di IG command di anti-riot unit to enta street and ensure say dem protect di lives and property of pipo.